Skip to main content

Posts

Showing posts from October, 2013

Inemesit

Hey Guys! So I attempted to write a blog post in Pidgin English and I like it! I'll try to translate it to proper English later if anyone wants me to. :) --------------------------------------------------------------------------------------------------------------------- Na wah o! How e be say 4 o'clock never knack since morning!? No be say I wan make madam come back, but I just wan make Sunday reach. Why I want make Sunday reach fast fast? E get this bobo wey dey do protocol for church, e foooiiine ehnn!  Nah him I dey look last week wey pastor talk say "Look how focused that young lady is. She's just soaking in all of the gospel of our Lord Jesus Christ!" I pray say na sermon go make me dey happy like that! This oga protocol wey I dey talk, e wan use style resemble my Obong wey leave me go Port. Him go do houseboy work for there like two years before them carry me too come Lagos find work. Him talk say, when he reach Port Harcourt  he go write me letter l